We Plenti (feat. Simi)

You don hustle tire, you no dey take holiday
You write application, you go for auditions but still
E be like say e no dey pay
Them don laugh you tire
Some say shey until your mate get aeroplane before you go make am
You beg God to make am but see
Everybody get lane
So my brother hustle, so my sister work
No condition last forever your own turn dey come
So my brother hustle, so my sister work o
Beans no dey cook forever, your own beans go done

If you see person wey make am o rejoice with them
If them ask you what's your own iyo take no offence
See this life na turn by turn o your time dey come because
No be only you kill Jesus we plenty for there
Oh

One day e go better, one day, one day, someday make we bet am
When they tell you money no be everything
You dey vex, you dey para
You say me sef i wan get am o
So my brother hustle
Kara woshe oh
No condition last forever
Your own turn dey come
Oh make you hustle, hustle, hustle, make you work iyo
Beans no dey cook forever
Your own beans go done oh, your beans go done

If you see person wey make am o rejoice with them
If them ask you what's your own iyo take no offence
See this life na turn by turn o your time dey come because
No be only you kill Jesus we plenty for there

So the person wey work hard o from night till dawn
Na the person wey go chop if e no give up

So my brother hustle, oh my sister work iyo
Owu no dey last forever, your own turn go come
So my brother hustle
So my sister work beans no dey cook forever your own beans go done

If you see person wey make am o rejoice with them
If them ask you what's your own iyo take no offence
See this life na turn by turn o your time dey come because
No be only you kill Jesus by yourself

So the person wey work hard o from night till dawn
Na the person wey go chop if e no give up
See this life na turn by turn o your time dey come because
No be only you kill Jesus

We plenty for there
We plenty for the matter
We plenty for there
No let your hope scatter
We plenty for there
Ah... Ahhh
No be only you kill Jesus
We plenty for there



Credits
Writer(s): Simisola Bolatito Ogunleye, Nsikak Okon David, Cobhams Emmanuel Asuquo
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link