Brother Man

I love this Kizzybeat

Baba I be dreamer
Wey dey chase the keys to my beamer, sensima
Sun wey suppose dey shine on me come turn to my dimmer

They call me Debhie, Debhie (yeah)

Me I dey like to dey talk my mind oh
Some go dey form like na dem do pass oh-oh-oh (say na dem do pass, oh)
When dem dey rate, dem go rate you last oh
But na dem act like dem love you pass oh-oh-oh uhh

Say no dey hate on your brother man (brother man)
Brother man hating another man eh
E no go bad if you help another man (another man)
Brother man fit help another man, yeah yeah
So why you just dey hate another man (brother man)
Brother hating another man
E no go bad if you help another man (brother man)
Brother man fit help another man, yeah-yeah

So dem dey call you zaddy for your area (hey zaddy)
Biggie man on top, you be girls dem carrier
My brother why, why you dey do like say you dey send nobody?
My brother why, even for your own dem paddy, you carry body

Me I dey like to dey talk my mind oh
Some go dey form like na dem do pass oh-oh-oh uhh

Say no dey hate on your brother man (brother man)
Brother man hating another man eh
E no go bad if you help another man (brother man)
Brother man fit help another man, yeah yeah
So why you just dey hate another man (brother man)
Brother hating another man
E no go bad if you help another man (brother man)
(Help another man, they call me Efe)
Brother man fit help another man (yeah yeah)

Okiemute na suffer head, poverty of high grade
Papa don retire, mama still dey do petty trade
He come kneel down dey pray, Lord biko come to my aid
See my friends like boutique clothes, dem dey your ready made
Oh Lord, why me, why me mehn
I can't even buy a tele
And I don kill too many birds, all na based on nearly
This shit is getting real, I'm freaking tired of the suffering
I chose a different way out of the streets but it keeps calling me
'Cause brother man no dey won dey help another brother man
Brother man no dey won dey see another man dey further man
Brother man no bother if another man dey suffer man
So na only you baba wey I know as my helper man

Baba I be dreamer
Wey dey chase the keys to my beamer, sensima
Sun wey suppose dey shine on me come turn to my dimmer
Friends I seek for help, all of them won turn me to sinner
Your grass is green today, tomorrow my own will be greener
Brother man, make you help your brother man
Make your brother man dey see you as a brother man
We no need to calculate, this no be further maths
Debhie call me and I answer as a brother man

Say no dey hate on your brother man (brother man)
Brother man hating another man eh
E no go bad if you help another man (another man)
Brother man fit help another man (yeah yeah)
So why you just dey hate another man (brother man)
Brother hating another man eh
E no go bad if you help another man (brother man)
Brother man fit help another man (yeah yeah)

So dem dey call you zaddy for your area (hey zaddy)
You be girls dem carrier



Credits
Writer(s): Deborah Bekere Asarah, Efe, Kizzy Beat
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link