Ghetto

Your boy Téra
Person wey dey cry still dey see road o
Him tell me call my number him no dey pick call o
Na so them puff my padi for bus stop o
Nothing we no dey see inside ghetto
Man wan be a lawyer
But we no reach the standard
No pali no raba
To take hustle for Apapa
As we dey suffer the suffer
Them mo some panya for uptown o
If to say people dey
Money dey
Ghetto boys
For dey smile

Ghetto
Boys in the ghetto
Many talents in the ghetto
If you know how the thing go
You go pity for the ghetto
Too much suffer in the ghetto
Different squad in the ghetto
Many don come and go
You go pity for the ghetto boys

Emeka been sabi play football
Sharp striker wey no dey dull o
Emeka dream na to play for Italo
And everybody been dey feel the boy o
Na hunger change him big dream
Better striker don dey do things
Emeka turned to a big thief
E don dey serve for kirikiri
E ye o
Awala dem dey wala
Snei and take even shoko dey para
And if to say e beta
Nobody go wan thief

Ghetto
Boys in the ghetto
Many talents in the ghetto
If you know how the thing go
You go pity for the ghetto
Too much suffer in the ghetto
Different squad in the ghetto
Many don come and go
You go pity for the ghetto boys

If to say beta hospital dey
Fatima for no die that day
Had it been beta road e dey
Container for no kill Ade
I dey para
Everybody wey die come be sara
Poverty don turn culture
But I know say no be normal thing o

Danjuma
Isaiah aka don lloyd
Abraham
Mad melon
Chi junglist
Naru
Make una continue to dey rest



Credits
Writer(s): James Okene
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link