Zombie

Zombie oh Zombie
Ye dey try to treat us like we be mumu
Zombie oh zombie

Every citizen gat a story to tell been ripped off our right some many things we still dey bear
Freedom of speech no more cause we self we dey fear
Make olokpa no gun us down because we won air out
If we start to fight now them say we be mere tout
Lazy youth na so dem call us because we no get mouth
Happy independence but bro we no dey happy oh
Flush all this bad government laws with harpic oh

Zombie oh zombie
Ye dey try to treat us like we be mumu
Zombie oh zombie

Brother man reason am
Why be say dem dey start project weh dem no fit ever finish am
Why be say dem give us power to vote and still dey rigid am
Money lose money lose tell me who dey thief am
E go better na wetin dem use to blind us fake promises every four years na so dem take dem bribe us
Suffocating every citizen like we be titus and if we rant too much for social media dem pipe us

Zombie oh zombie
Ye dey try to treat us like we be mumu
Zombie oh zombie

Don't you ever treat us like we be mumu
I hear say dem don pass bill
I hear say dem don sign am
I hear say dem fit badge in our doors now with no warrant
I hear say we no fit look clean again and walk free say dem go pull up with their korope and we go pay fee
No freedom of movement
No freedom of speech and if you speak too much English dem go say you dey preach
You better give us all the money weh dey for your account
Or we go beat you so tae you go end up for six feet

Zombie oh zombie
Ye dey try to treat us like we be mumu
Zombie oh zombie
Don't you ever treat us like we be mumu



Credits
Writer(s): Ovburie Daniel
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link