We No Go Gree

Yeah

Many people dey cry for here
Many people dey die for here
Many people suffer for here
Many people no chop for here
Omo na so e dey be
Be like say everyday na for thief
Be like say our green no green
Oluwa come and help your pikin'
Wetin dey for my mind fit to fill the page
I wonder if this country be my heritage
Man de hope say this country go see better days
But if I do nothing, wetin' I dey pray
We no fit take all this nonsense
Me, I no go take am, make I confess
So my people, make we stand up
To war, make we stand up
All my people, come join me sing

Bad belle people o
We no go gree
We no go gree o
We no go gree
Corrupt politicians
We no go gree
We no go gree o
We no go gree
All them promise and fail o
We no go gree
We no go gree o
We no go gree
Fake friends and the enemy
We no go gree
We no go gree o
We no go gree

Yeah
Amen, amen, amen, amen, amen, amen, amen, amen
Amen, amen, amen, amen, amen

I done seen these wonders
People die in numbers
Marriage go asunder
Economy de under
Make we pray to Jah
Still we no understand
How he go answer
We still de do yanga
Light issue
Water issue
E bad say to clean your yansh
You no get tissue
After you don kpai, who go miss you
How many times money even reach you
For family to chop egusi soup (Chei)
We no fit take all this nonsense
Me I no go take am, make I confess
So my people make we stand up
The enemy de back up
All my people come join me sing

Bad belle people o
We no go gree
We no go gree o
We no go gree
Corrupt politicians
We no go gree
We no go gree o
We no go gree
All them promise and fail o
We no go gree
We no go gree o
We no go gree
Fake friends and the enemy
We no go gree
We no go gree o
We no go gree

Yeah



Credits
Writer(s): Nsuhoridem Udeh
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link