My Prayer

Lord answer our prayers
Answer our prayers lord
Ah ah yeah
I done tay for this game nobody won know me
Because I never blow nobody won feel me
I no sure say my destiny helper fitdey hear me
BABA send am make he fit locate me
My Papa no fit suffer make i carry am for head
Oh Lord see my life where I go chook my leg
Too much paracetamol just for man head
I need Shawamma no more coke and bread
I done tire to dey je gbese
Abeg make you help me je ki ri nko she
I won follow convoy to dey go malay
BABA scan my life Just like an ex ray ye ye
Ye paripa my worm dey dance
Paparapa
Moti mu omi Mofemupa
Kilo sele Wo sope ebi Pa pa ye

Answer my prayer
Jesu kristi
Answer my prayer
BABA to wa Loke
Make you Answer my prayer
Na when you go answer me
Na when you go answer me

They say if you are born poor no be your mistake
But if you die poor Na your disgrace
I dey hustle all day Over concentrate
I done dey grow old Lord I won elevate
Ah Baba show me the way
Make i no be like boy Wey dem throway
Ye Ye I won calculate
NO be for naira or dollar But for kuwait
Yepa Mofe blow Mofe runtown
I no won get today
and tomorrow I fall down
Baba God I won chop life
E done tay Wey I sign
I need that contract
Give me this money Make i see life chop
When I go get ba So I go fit fill my pot
I done dey hungry My Belle done dey hurt
Too much of life exam Lord I need result
I dey hustle all night Mi oki su
Na only you fit bless me BABA Jesu
Mofe owo mi ofe esu
Give me that money Jeki ota mi sare lo su
Lord answer my prayer
Make my enemies no use me laugh
Babe lord I won reach Cambodia
I no won blow when I done die
Ah ah

Answer my prayer
Jesu kristi
Answer my prayer
BABA to wa Loke
Make you answer my prayer
Na when you go answer me
Na when you go answer me

I pray God answer our prayers
We hustling just because
We don't wanna die poor
We still have to buy Bentley for mama
And build house for papa
Lord Bless us
Bless we young niggas
Ah ah
AC

Answer my prayer
Jesu kristi
Answer my prayer
BABA to wa Loke
Make you answer my prayer
Na when you go answer me
Na when you go answer me
Answer my prayer
Answer my prayer
Answer my prayer
Answer me
Answer me



Credits
Writer(s): Clinton Ahize
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link