WHY

Why you wan dey act like sey
You nor dey see
Why you wan dey act like sey
You nor dey hear
Why you wan dey act like sey
You nor dey feel am
We don dey para
We don dey gather
Notime to dey stammer
You nor fit divide us
Why you wan dey act like sey
You nor dey see
Say NIGERIA jagaga
Everything scatter scatter
Presidency Nyama Nyama
Poor man dey hunger hunger
Bad governance we zoom zoom
Bad politicians doom doom
Why you wan dey act like sey
You nor dey hear1
Sey NIGERIA Jagaga
All that you know na to wire wire
Take pictures and Maya Maya
Leave the masses to dey suffer How far

Why you wan dey do like this like that
Shebi you say we go dey alright
Everyday NIGERIANs dey die
Calling On God we don tire
Everyday you go out in morning
You wan go hustle
Police stop you
Dem go search you
Collect the one wey you get
Dem go put accusations for your head
For wetin you know nothing about
If you nor too drag
No gunshot
If you come too drag
Na gunshot tah tah
Another son Dead
Why you wan dey act
Like sey you nor dey see
Why you wan dey act like sey
You nor dey hear
Say NIGERIA jagaga
Everything scatter scatter
Presidency Nyama Nyama
Poor man dey hunger hunger
Bad governance we zoom zoom
Bad politicians doom doom
Talk to us Mr President
Listen to our Voices
Treat us better
We won't refuse you service
Make our Nigeria great
Or resign with all due respect.



Credits
Writer(s): Kennedy Liam
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link