Journey

Bodeblaq in the building
Blaqa Blaqa Blaqa janta manta super stricker pata alhaja Han

On this journey of been famous
God no shame us
Fans go dey hail us
Depression no go hold us
social media pressure
No go reach make we give up
Those wey dey look up to us
no go con dey underate us

Say we dey pop before
we no pop again
No go be our portion
we no go hustle in vain
Those ones wey no get direction
Dem no go block our way
Drugs and all other distractions
no go lead us astray

On this journey of been famous
bad roads no go kill us
As we dey travel for shows
promoter no go rip us
Dj go dey plays
OAPs go dey hail us
Na those ones wey too like money
Radio station go lay off

On this journey of been famous
SARS no go kills us
They go soon stop to dey
ask who we be when they see us
Those wey no Dey under rate us
Go later pay to see us
Them go stand outside eko hotel
Cus the inside filled up

On this journey of been famous
Girls no go rape us
We gon be so blown
Even olosho no go dey bill us
Sugar mommies go chase us
Their girls friends sef dey chase us
Make God give us the strength to say no to every temptation

On this journey of been famous
God no go shame us o
God no go shame us o
God no go shame us o

On this journey of been famous
God no go shame us o
God no go shame us o
God no go shame us o

On this journey of been famous
Media no go defame us
All dem blogger blogger no go see something nail us
With the blood of Jesus
Billing no go kill us
All our village people no go sabi road to lagos

On this journey of been famous
Helpers go locate us
People wey Dey use people no go see need to use us
Investors go dey find us
Endorsements go pile up
Anywhere we they calling greatness na we dem go dey mention

Say we dey pop before we no pop again
No go ever be our portion we no go hustle in vain
Those ones wey no get direction no go block our way
Drugs and all other distractions no go lead us astray

On this journey of been famous
God no go shame us o
God no go shame us o
God no go shame us o

On this journey of been famous
God no go shame us o
God no go shame us o
God no go shame us o

On this journey of been famous
God no go shame us o
God no go shame us o
God no go shame us o

On this journey of been famous
God no go shame us o
God no go shame us o
God no go shame us o

Bodeblaq in the building
Blaqa Blaqa Blaqa
Janta manta super striker
Counter attacker Rasta master
Karakata Pata Alhaja forkanizer
Continental faworaja



Credits
Writer(s): Bode Blaq
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link