Benediction of a Drunk

Oh lord I don come
To tell you all my pain
Sometimes ah go wan die
Sometimes ah go wan live
Sometimes ah go dey craze
Angels singing halle
Demons dancing aje
Olohun gb ọ e ah no finesse

Kolokokokokokoko
Kerekekekekekeke
Abi make I go my native land
Go sing in my mother tang
Dem kuku don curse me gan
I sing for love
I sing for poor o
I sing for rich
I ditch dem wrongs o
I sing for thief dem tie for road o

Oh, oh, oh
Agbero wey dey work from dawn
E reach dusk e never tire
Sweet melodies
I sing for beggar wey dey church
Sambo wey dey pick
Metal dadadada
Painter ati oda

Oh lord give us peace
Things wey eyes don see
Me know say me no holy
But how will I survive this
If ah no do me wrongs
If ah no paint me blood
Benediction of a drunk
Benediction of a god

Kolokokokokokoko
Kerekekekekekeke
Abi make I go my native land
Go sing in my mother tang
Dem kuku don curse me gan
I sing for love
I sing for poor o
I sing for rich
I ditch dem wrongs o
I sing for thief dem tie for road o



Credits
Writer(s): Oreoluwa Omotoso
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link