Make Am

HmmmYeye, Oh Nah
Oh oh oh oh oh,
Oh oh oh oh oh oh

Everyday I gotta hustle, I gotta grind
I wake up Every morning with money on my mind
I dey work I dey pray I no dey sleep in the night time
Oluwa shower your blessings na since I dey line, yeahih

Oghene na your boys and girls we don come again
I know say angel Gabriel go say we don dey disturb again
I'm just another one from the ghetto
But till you bless me God I no go leave your gate oh
My dream is to be a superstar
When I hold mic everywhere go scatter
I wan enter ShopRite I wan charter
Record wey my mates no fit break God I wan shatter
See, I be loyal boy I noh dey, rise chest
I just wan commot my mummy from the market
Give her money to dey chill maybe buy shares
Then my daddy go retire to a nice rest
God our blow dey your hand no be man hand
The journey don tey make am quick abeg add hand
Bless us with long life and with raba
Make the accountant dey count till she taya

Sbebi na money we dey find we go make am
Anything i puti my hand make you bless am
Steady we dey push we dey grind we go make am
The life we dey dream of my guy we go get am

Yeah, Came a long way from the ghetto
Jah we no get person and I hope you no go Leggo
Humble boy me I start the road with no doe
But I get drive pass person wey dey sell motor
Cheee, Oluwa we wan collect,
On your hotspot God abeg we wan connect
We dey find money cos as so e be noh fit come dey find us
Oluwa shine ur light we noh mind if e blind us (Hey God)
See this year mhen i gats blow
Get money anyhow like i be pablo
I dey imagine wetin dem go blog oh
Son of a market woman in a Benz oh
God at this point everything into you hands
20 milli every show Jah I go e no go bad
God na your hand I dey so make my light to shine
This little light of mine, na you fit make am bright
Let's Go

Everyday I gotta hustle, I gotta grind (Oh oh oh oh oh)
I wake up Every morning with money on my mind (Oh oh oh oh oh)
I dey work I dey pray I no dey sleep in the night time (Oh oh oh oh)
Oluwa shower your blessings na since I dey line (Shower your blessings)
Yeahihhhh
Sbebi na money we dey find we go make am
Anything i puti my hand make you bless am
Steady we dey push we dey grind we go make am
The life we dey dream of my guy we go get am

For now I'm still a broke boii, Unable to dispense cash
Oluwa gimme Rolls Royce, Make I fit speed pass >>>
All these Enemies, wey dey try to bring the boy down
Make the blow loud make them no fit keep the volume down

ReyKnow Na, Star of the Show, Kelz Nena
Broke Boy, Big Dreams, Trust the Process!



Credits
Writer(s): Kelvin Emonena
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link