Pressure (feat. Eddievybes)

Don't pressure me
Don't pressure me
Allow me do my thing
Na God Dey bless person
(Na God Dey bless person)
I say Don't pressure me
Brother Don't pressure me
Allow me do my thing
Na God Dey bless person
(Miles answer to the world)

Things going wrong
I know
If you Dey complain?
For life and hard time
Try reach ubth
Observe who nor Dey healthy
You go know say good Health
Alone na blessings
If you get woman
Happy And thank god
Na grace
Street boys plenty
Nor be u bomb or chat work pass
Bros we plenty But the winning nor reach everybody
Let who wan go go
And who wan stay stay
Barcelona still Dey ball without Messi
Nor go Dey owe anybody
To be man nor easy
Na só the pressure wey follow am come plenty
True love is now judge by credit and debit
Who are we to blame
The world is getting worst everyday
I see young brother going out
For the chase of the money bag
The love you get from people
Determine the amount of money wey you get
Na boy wey get money na girl dey use dey brag
Who papa and mama suppose Dey give bread
Don comot house go find daily bread
The street rule remain the same
Either you die rich or die poor
Either you soppy or you fuck
So far you cum
Nobody really cares
How you get rich
So far if dem drop account
You send money come

Don't pressure me
Don't pressure me
Allow me do my thing
Na God Dey bless person
(Na God Dey bless person)
I say Don't pressure me
Brother Don't pressure me
Allow me do my thing
Na God Dey bless person

December don reach
Stupid people is under pressure
If the table na about fine picture and clothes
To impress others
You nor fit see me there
One seconds I carry my Chair run
Majority of the poor man
You see today
Was once rich
On their youth day
The better tomorrow you want
Depends on what you do today
Who poor today fit still poor tomorrow
Who rich today fit still rich tomorrow
Some richies come early
Others come late
Una fit be the same date
But nor be the same grace
Nor let anybody pressure you
Do as your power reach
You nor be sugar daddy
Truck pusher nor get money
But e nor lazy
Miles answer to the world
Oluwa I loyal o Make dem regard me
Oshamo

Don't pressure me
Don't pressure me
Allow me do my thing
Na God Dey bless person
(Na God Dey bless person)
I say Don't pressure me
Brother Don't pressure me
Allow me do my thing
Na God Dey bless person



Credits
Writer(s): Nelson Isaiah
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link