Breakfast

You be yeye girl and you think say I no know
But I no fit to talk say I no do small wayo
I no fit to de vex say you first catch me mumu

Make e no be like say I kon de claim innocence oh
Cos I know say this breakfast them serve am for two
I no even Dey sure if I for last last repent oh
But shebi you no know say the boy be get plans for you
I swear e gats be juju
Cos I no wan believe say I be clear eye mumu
I no talk say this breakfast Wey dem serve no be for two
No be say you no chop but na me chop belefu

Shey Na bone straight human hair
1942 and Moët
I just collect change I no fear
I enter Benin go de find bae
And you no fit whine folake
She know say good girl no de pay
But if she see moto Wey I tear she go feel say the hungry no Dey
I'm a city boy let's be clear
It's me, you and tequila today
And if I'm smelling love in the air man
I go find where oxygen Dey
Shey Na lifestyle she wan see
I go blind am with the Cartier
But if Na breakfast she de serve
I don de starve no be today
I've been grinding all of my life
E be like say Na Wetin de pepper them
Sharpen eye, no be knife
E get why bambella still de check LM
Latex still on bullet proof
I never ready to get children
But better check on your wife
Before I vex bend her like empty gen

Make e no be like say I kon de claim innocence oh
Cos I know say this breakfast them serve am for two
I no even Dey sure if I for last last repent oh
But shebi you no know say the boy be get plans for you
I swear e gats be juju
Cos I no wan believe say I be clear eye mumu
I no talk say this breakfast Wey dem serve no be for two
No be say you no chop but na me chop belefu

Body don tell everybody
You don calm now I don wreck
All my jokes no kon Dey funny
All my messages you no check
Any small chinkele money
Them go come back come de beg
How you no go say I be goat when
All these girls de drag me for neck
Save your words, I no be keeper
Plenty talk no de full basket
Student don de turn into teacher
She don vex go de pull her skirt
I get 1 Wey Dey send epistle
Every Sunday she Dey collect
I get 2 Wey never kiss
But I get 3 Wey no fit repent
Person Wey no gree for my finger
Those your nails Na you go paint
Any small thing you Dey ginger
If Na big thing you go faint
I get one Wey de go winners
So Na six days she de ment
She don finish my Hennessy
But every Sunday she de repent

You be yeye girl and you think say I no know
But I no fit to talk say I no do small wayo
I no fit to de vex say you first catch me mumu
But if you fool me again then I go sure say I be fool
I swear e gats be juju
Cos I no wan believe say I be clear eye mumu
I no talk say this breakfast Wey them serve no be for two
No be say you no chop but na me chop belefu



Credits
Writer(s): Joshua Amadasu
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link