Lamba & Motivational Express - Vol. 3

The voice you are about to listen to right now
Physically and spiritually could actually
Lead you not to win financially
It depends on how you see
The physical from the spiritual
Na u dey say u wan do ritual
How your rich take tual
Adesuwa self no see ritual do
When no be oduduwa wey dey spiritual
How far have you gon
Before you go dey ask another person
How far
If the person come tell you
How far him go far
You fit solve the problem
There is a difference between
Wahala and problem
Just that one na english
And one na native language
Problem no dey finish
But we dey pray
Make the problem wey go come
Make e no pass wetin dey for our account
Everything u go dey take sugar
You no know say
He go cause low sperm count
Election don reach
You no collect PVC
Don't you know your vote count
You dey dey shout Nigeria no good
Were you part of those that
Change the government
Because this is a regime of democracy
Democracy means
You go demo before you crazy
And If you crazy thank God o
No demo mad
Government of the people by
The people and for the people
Who are the people
People could actually be one person
Because some people dey
Na one dem be
No be quantity na be by quality
My one shoe
Fit buy all your tea
Wey you put inside shoe
Whats your issue
I shit I say ah give me tissue
You say
How far is my tea in the shoe
I go warri any small thing
Dem go say shoo
I say calm down
Put yourself in my shoe
No means say
You go enter my shoe
My shoe dey smell o
If you enter you fit no survive
You fit comd end up to swell
He go come be like say
You get elephantiasis
How far
Three plus three ńa six
Four plus three na seven
Thats why 7 hate 9
10 come say 11 how far 12 13 hey
I dey 13 Promax 4 years ago where we're you
Were you max
Eministandard
Noo
But if I talk that Na me 2 times
You know say na problem he go give me
Talk am 2 times na
Na me na once I talk am
But if you go say na me times 2
Who go check u go check you
Who go double pay go double pay
If he sleep kill am
Bizza Bizza wey no fit chop pizza
Talk say him na ebira
My name is Oyiza
Shut up there hafeeza
Common give to ceazer
What belong to ceazer
Even if na izal
Where my producer
Drop some motherfucking shit
How far
Your prick dey stand
Your account balance no stand
Eyah
Who dey deceive who
You dey shout say your
IPhone dey stand
But your family stand
There is a difference between
Shorthand and long hand
My short hand might be
Longer than your longhand
It depends on where my shorthand
Is start from
Capless
Irritability is the response to stimuli
In Philippine
If you wan know
Whether woman wear yanch
Chook am pin for yanch
If she feel am my brother shes
In feeling pain
Hannah buy corn
He boyfriend buy Honda
You come dey shout Anaconda
Calm down why you dey cast their update
Castina no cast me na
Even broadcaster no broadcast her
Na you wab dey cast her
You dey shout say you don fuck her
You sure say na she you fuck
Abi Na her lap you fuck
What a lapses
Ewoo
Won pe e legbon
Oogbon o wà n gbo ra ẹ
Gbọn Gbọn Gbọn
Gbọn kì nìyẹn
Gbọn kí nìyẹn ko le mo nà
Hey If you no get yanch
No get yanch no shake am o
If you no get yanch
You are not suppose to shake yanch
Na department
You come get yanch you no sabi shake am
You're so unfortunate
You're so unfortunate
We suppose dey beat you every tuesday
Ewooo
Now what is today
Today is Monday why
Because we're mourning poverty
I sat at home on a Saturday
You're complaining
What am I supposed to do
Even on a Sunday Sun no dey
OH my God
Edede
How far you u dey there
Dele odule self come say
Hey who dey
Nobody dey
Stop to dey
When dem no dey
Enemzy wey dey do AC
Say AC no get enemy
AC get enemy o
Na when cold catch you
You go know
Wetin no favor you
Na corruption
Wetin favour you
Na connection
How far
Awa ó gbó ń kan kán
Àwa ó rí n kán kàn
Báwo lase fe rí nkan ń kan
Ta a gbo nkon
A ṣá ń fà gbó ni ó
A ṣá ń jẹun ní o
A dẹ' sha ń dobo
Fa gbó
Jẹun
Dobo oh shiiit
Now ladies and gentlemen
Ìs either you're alive or you're dead
Is it not better for you to be dead
Than to alive but you're dead man
It means u don't have money
Who wan para for family member
Wey get money say
He come late to family meeting
Na dem go even advise am
If you cant come stay
Money good ó
If your family member call you
Ńa money go end am na dem go bill you
Billiamin
Na who get money na him no dey fear billing
He go pick anybody call
Because number 1
Him no reap anybody
Him no snitch anybody
No problem big pass wetin he get
No go pick pocket
Na who get plug dey find socket
No pick my pocket ó
Because if you pick my pocket
I go vex
I go tell you say
How far your socket get light
How far where there is light
There is no darkness
And where there is normality
There is no madness
If u get Belle for me
You do abortion
You abort destiny
You know why
You are not destined to born greatness
And there is difference between
Guinness and greatness
They started with G but some G pass some G
Ṣe ó jí
Abí ó jí
Ṣe ó ń jí àbí ó jé virgin
Fi lè fà jin
Jin láti inú well nibo fà jìn
Are you a virgin
No I'm flying virgin Atlantic
I no know where you dey carry me dey go
Where you dey carry me dey go
Where you dey carry me dey go
We have only one Àgbá
Any other Àgbá is Agbaya
Throw way
Be sì agba kò ka gbáko
You sabi talk you no thick
You come talk say you dey tiktok
Who are you
How dem wan take follow you
The only person wey go follow you
Na your chief priest for your village
No be cubana ó
He's even following you on instagram
Following you on twitter (follow follow)
I just dey wonder
How your guardian angel
Dey see you when you dey masturbate
Guardian angel una try ó
Even when we dey fuck up
When we know say nobody
Dey see us but you dey see us
Guardian Angel well done
If your guardian angel
Dey blow ice and you no wise
You no know the meaning say
Guardian abgel dey blow ice
He mean say no matter the size
Of he cap he can never capsize
He never sleep nor slumber
Even plumber can never plumb
Where there is nothing concerning her
Ehn fi lè fún naa
Arúgbó ojo adàgbà òye
Rock of ages
How far
Ọjà bo kò fò
Kò jabọ' dada ni o
No dey tell me say you no go fall
I wan fall but it depends on where I fall put
Who fall on top tiles different
From who fall on top bed
But some tiles soft pass some bed
The moment wey you think say you wise
Na that time your foolishness start
Because the more you look the less you see
Don't compare a river to a sea
Oceanic bank never for once
Tell you say he derive him name from Ocean
He derive his name from ó ń ṣàn
Erosion is going is a gully movement
Porosity which means a down ward
Movement of water
Which we call the H20
You dey blow ice you no get update
I swear to God
You won't live to count the date
When your date will fornicate
And you prostrate straight
In front of that cancer called prostrate
Dem say cancer dey
Saggitarius dey
Scorpio dey which one be your own
You no even know
How you wan take know
When the opposite of yes na no
Kékeré Ìjẹ'bú owó ni
Agba Ìjẹ'bú owó ni
Má be sì ó
Alangba ó ń kẹyin sì a ra ógiri
Ayé! ẹ má kẹ́yìn sì mi
Fi lè fún o
Ayé yàtò sì ayé
Na color na him different
Dem catch u for where dem sell igbó
You dey tell police say I don't smoke
Why are you there
Are you there to choke
Olófo
Use dem before dem use you
Kill dem before dem kill you
Because if dem kill you
Dem go pray for forgiveness
Because the God
We serve is so merciful
Bismillahi Rahman Raheem
Alhiamdulilahi Robil al hameen
He's the most beneficient
And the most merciful
Ṣe ó ti ye ẹ bayi
Kill dem before dem kill you
He better make you see dem
Before dem see you
Are you seeing what Im seeing
He that is mimi
Is greater than he that is in mimi
Who's mimi miracle
How far mimi u get belle
At the same time Mimi na indomie
But if you wan buy mimi
You go say I wan buy indomie
Which indomie
Indomie no be indomie
Hustle make dem dey use you do
Example for good thing
Mummy I wan buy Maclean
Which Mac lean close up
No be two of them be toothpaste
You no get money
You dey say paste your aza
What are you pasting
You're nothing but a foolish waste
Ladies and gentlemen
Na who fuck dey get pain for waist
Producer u no go waste
This mixtape no be mistake
You know why
Because the past tense of take is took
Don't mistook your taking
Which is the present continuous
And don't take your took
Which is the taken
Which is the past participle
Because na people wey go party
Dey get parti people
Hey calm down
What is your particular
Dem no dey carry cooler go party again
Na collar dem dey carry
What is your parti collar
Calm down make you no run down
Na who short dey see money for ground
Coz their eyes is so close to the ground
No matter how short a man is
He too can see the sky
Dem say the sky is blue
Do you know sometimes
The sky dey white
But he blue ó he blue
Na ur eye na him white
Even Machala wey dem dey call white
Is not that really white
Nobody is perfect and
Nobody is close to perfection
How far if you chop too much sugar
You go dey shit igbe shish án
I'm OK should I make this a conclusion
How far file fún na
Dem say I be beast
You wan do bread you no get yeast
How far
Ehen na
What a gist
Even gist loaded try load gist
But he no load you know why
The loader wey suppose load the gist
Don go gist pass wetin he suppose load
Hey producer load your gist
Common wake up idiot
Jí masun
Na who get money suppose sleep
Elon Musk no sleep you dey sleep
You think say Elon Musk fit go hell fire
With that kind money
It's not possible
The money he has can conquer
Those that are suppose to conquer him
No plan to do bad for person
He fit be say na that person good
Make you still dey alive
You get bald head no compare am
With who get dread
And you still fit get bald head
Make you get dread
You get dreadlock
No mean say u go get goodluck
Goodluck Jonathan
Still get goodluck because wetin
He Ebele no jónáthan
Thank you ladies and gentlemen
Because you know say on
Wednesday he go dey for club
If he no come wednesday
He go come friday
How far
On a friday I no see something to fry
I fry my hair because
I wan to look like Oyakhilome
Hello men
The plural of man na men
And some men dey
Dem wicked ó
If dem enter you
You go run
Respect to those men
Wey dey represent the color wey no get color
How far
Stop playing now
You're laughing and you don't have money
You come even horny
Your honey is bitter
Even origin bitters self
Dey vex for you because
You dey compete with am with bitterness
What's your greatness
When you don't drink Guinness
Producer
How many minutes we don dey
One minute silence
For those that are prudence
Excellence can never
Be define by success
You know why
Lagos which is the center of excellence
Is not actually the center of excellence
Ńa Katampe dey centre
Katape se orí ẹ pè
How far
You say ehn you dey stay cantonment
Your canton ment
Dem dey tell us 7up
Dem do mistake it suppose to be 7 ups
That's mistake in English language
When there is concord
Between two friends
For long
Somebody is hiding something
From the other
Una most quarrel na because
The quarrel of two lovers
Is the renewal of their friendship
Why you no quarrel
What are you hiding from me
You're my friend and
You never mess
For my presence before
When you wan mess
If you no mess now
God go mess on you
Imagine say God mess on you
God wey he talk say he fit use
One finger destroy this world
He come mess on you
Tí Ọlọhun ba mess ẹ
Wáa gbeskelemẹss
Producer! Is my session still here
Now producer say it's OK
But you know it might not be okay
Torí to bá lọ tẹ K
Which is the Keyboard
Ó lè lọ ké ó
Bí kò kú lọ dé má je BKK
Má sún mọ' ó
That guy dey sleep
Chook am knife for neck
That other one dey sleep
Oya carry calabash rub he head
You dey sleep house of billionaire
You dey sleep with two eyes
Dem give you ice you say
You no I don't do ice
And you no even wise ó
You have never slept on tiles
I know my America called plies
How far
And plies is the plural of ply
Plywood no get hood
How far
Your bad fit be my good
And my good fit be your bad
You have no right to tell me
What is good and what is bad
It depends on perspective
Wetin poor man see
Rich man fit no see am
He no need am
What is the relationship
Between poor and rich
It is very far
You cant be sitting on a fence
When we talk about wealthiness
You can't confuse God because
God created the God of confussion
Which is Lucifer and he is the god of cruise
Even person wey do boat cruise
He never enter boat before ó
He just dey catch cruise
How you expect make
Alora drown
Kàkà kò fi ẹiyẹ ṣe yẹ yẹ
Yẹ yẹ wọn a di ayẹyẹ
How you expect make
Aiye ṣe ayé
Kò possible na
You come expect say ehn
Arobaga go swallow daga
Make he affect am
Your father
Your mate dey catch flight
You dey catch feelings
Abeg catch cruise
Nothing dey this life
You say you be Agbero
You no get any bruise
Ó fẹ' kó ṣe
Agbero ó mere sá
Where you wan start from
How you wan take start am
Person wey naked
Dey chook hand for pocket now ó
Use your head and you can never
Climb a ladder with you two hands
In your pocket coz you will surely fall
Calm down o
No too shout say you dey ball
He get where you go go
If you ball you go fall
Calm down
There is a difference between
Mall and hall
Na just the beginning of the spelling
Thank you for listening to this episode
Expect something else
I no go sell am but it will be sold
Who new today go old
He better make you hold
Than make you owe
Na owe you dey owe
Àbí you hold
Take care
This is the voice of
You don save am
Post am
Post am
Post am (Echoing)



Credits
Writer(s): Oshinubi Lukman
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link