Condition

You no fit talk
Man dey suffer him no fit talk na conditioning

They say a problem shared is a problem casted
This one e go need broadcasting
This pain it is everlasting
E no be film e come be like acting
If dem no teach you my brother
Tell me how you go know
Cause me self I no know
Say this world e no pass the one wey we see for ground o
Dem tell me say
Make i try make heaven
Say make i no worry
About the Worldly things oo
But e dey worry me
Rent dey worry
Poverty worry me
And
Politician worry me

Man dey suffer him no fit talk na conditioning
If you dey suffer you no fit talk na condition you dey
Man dey suffer him no fit talk na conditioning
If you dey suffer you no fit talk na condition you dey

My people suffer
Government show us shege
As we dey suffer
Pastors dey show us steady
My people suffer
Government show us shege
As we dey suffer
Police dey ask us
You go dey waka for road
Police go stop you
E ask for particular
You go dey waka for road
Army go stop you
E whip your yansh
But e dey worry me
Rent dey worry me
Poverty worry me
And
Politician worry me

Man dey suffer him no fit talk na conditioning
If you dey suffer you no fit talk na condition you dey
Man dey suffer him no fit talk na conditioning
If you dey suffer you no fit talk na condition you dey

Government show us steady
Na conditioning
If you dey suffer you no fit talk na condition you dey
Army dey whip us for yansh
Na conditioning
If you dey suffer you no fit talk na condition you dey



Credits
Writer(s): Alionye Martin-ikpehai
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link