Wetin I No Fit Do

As I woke this morning, I just dey think
I just dey think, I just dey think
Say wetin I do wrong o?
The way things dey go, my brother things be slow
Be like say make I go rob bank o
People dey jolly dey go
Me I dey here dey contemplate
Brokenness never dey good oo
E fit make you look like zombie
E start dey make you dey wonky
But I no say one day ego be o, because

Wetin I no fit do? Baba God edey for my body
Wetin I no fit do ooooooooo
Wetin we no fit do? Jehova go provide o Dolly
Wetin we no fit do eeaa

This life never bi easy, so make we dey plan
Make we dey plan, make we dey plan well well o
As we dey plan, make we dey pray
Make we dey pray, make we dey pray eeaa
Make we dey try dey connect
Help a brother make he collect
No bi only you, for enjoy o
Help a sister make she direct
I beg always dey show respect
Baba God edey watch o
You for always remember
From January to December
Make we dey help one another ahhh
Anything go fit happen
This world is full of surprises
As you dey top make you never relax o
Never forget where you come from
You for always dey stay focus
My time go come wey me sef I go shine o
My enemies go shame
I say this life never bi easy
But no matter what dey come
One day I go rise o, because

Wetin I no fit do? Baba God edey for my body
Wetin I no fit do ooooooooo
Wetin we no fit do? Jehova go provide o Dolly
Wetin we no fit do eeaa

Wetin I no fit do? Baba God edey for my body
Wetin I no fit do ooooooooo
Wetin we no fit do? Jehova go provide o Dolly
Wetin we no fit do eeaa

Wetin I no fit do? Baba God edey for my body
Wetin I no fit do ooooooooo
Wetin we no fit do? Jehova go provide o Dolly
Wetin we no fit do eeaa



Credits
Writer(s): Ernest Twum
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link