Shame Us

God no go shame us
You see me Dey go up high
We be like Vapors
Na from there u go Dey hear my story
I just Dey get Favors
Oluwa don become the chain
You no fit break us
Na this same matter na him Dey sub!
Look at my life
Look at the fights
Look at the pains
Look at my Gains
You forget my Agony
Sorrows and blames
U envy my expresso
You no dey shame!
Why you Dey bite me
Why you hate
Why u wan block me
You know my Fate
I am too spiritual, I no be fake
I'm so original, I no dey fake

God no go shame us
Make we keep the hope alive
God no go shame us
Make we keep the hope alive
(High high high high)

There To many Haters
Too many fakers
Too many bad belle wey wan Phuck! Us
To many reasons why I don Dey stay
Away from many brothers wey Don lose focus
To many excuses go make you go down
I be that moving train wey no Dey back down
I be that reason una just dey yarn Opata,front and back
Shoot una bang bang!
No my fault say I Dey elevated
No my fault say my pepper rest
No be my fault say u dey irritated
No be my fault say u too dey vex
No be me make u just dey waka'bout, all around,u dey yarn nonsense
No be me bring u so much stress, get up grind, stop this nonsense

God no go shame us
Make we keep the hope alive
God no go shame us
Make we keep the hope alive
(High high high high)



Credits
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link