Babanla Nonsense

Yeah Yeah
Dem don come again oh (tell them oh)
So, after eight of suffering and smiling
The election is upon us again
And we are here to continue with all the

Babanla Nonsense
Babanla Nonsense
Babanla Nonsense
Babanla Nonsense

Fuel dey scarce, No money
(Babanla nonsense)
People dey para everyday wahala
(Babanla nonsense)
Give us change, dem change money
(Babanla nonsense)
They carry all the money dem hide for banks
(Babanla nonsense)
New notes zero circulation
(Babanla nonsense)
Election dey come, they want make we vote
(Babanla nonsense)
My money dey for bank i no fit collect am
(Babanla nonsense)
This thing dey vex me na why i dey hala say this na
(Babanla nonsense)

Babanla nonsense oh
(Babanla nonsense)
Babanla nonsense oh oh o... oh
(Babanla nonsense)

Everyday suffering and smiling
(Suffer suffer, suffer suffer)
My people no Sabi their rights still
Dem no believe say them get the power
(Power)
Na why all these baggers still dey ride us, (vroom)
Them dey loot us, dey kill us, dey laugh us
(All of them)
We dey adapt to many many nonsense
(Rubbish)
Ah, Nonsense wey no make sense
(Hmnm, at all)
No proper health care system
To finish for school na palava, (palava)
Eii, see me see wahala, (wahalah)
Aii, Nigeria jagajaga, (jagajaga)
Hm, Everything scatter scatter, (scatter scatter)
Wuru wuru,(wuru wuru)
Wara wara, (wara, wara)
Common man suffer suffer, (suffer, suffer)
Rich man Gan sef e dey hala
If you dey Para
Follow me hala say this na

Babanla Nonsense oh
(Babanla nonsense)
Babanla Nonsense oh oh ooh oh
(Babanla nonsense)
Babanla Nonsense oh
(Babanla nonsense)
Babanla Nonsense oh oh ooh oh
(Babanla nonsense)

Only the people can change this nation
(Tell them)
If we work together
We know the problem, we the solution
(One nation)
To stop corruption and all this
Babanla nonsense oh oh o... oh oh

Ye
BABANLA NONSENSE



Credits
Writer(s): Simi Jobi
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link