Daddy Wey Dey Pamper (Gbedu Version)

Moses bliss Ft Greatman Takit, Prinx Emmanuel - Daddy wey dey pamper

Daddy wey dey pamper
Daddy wey Dey bless
Forever you're my father
Na u dey give me rest
When I look around
I see your faithfulness
I'll bow down on my knees
Cos na u wey be the best

Eh
Elelele
Daddy wey dey Pamper
Daddy wey dey Pamper

Oh Lord

Say,
One
Eh
Say I been tell them before
Make them kilo fun ota mi
E get why I talk the way I talk
Like say me no fear nobody
Omo if you wanna try the boy
You go like to tell me who's your daddy
Shey you want get beef
With the God of all flesh tori
Omo, that's my daddy

For my life I dey lush, lush
I turn Ajebutter I dey posh, posh
Blessings dem are coming in a rush rush
Angeli protect me is a must, must

I be busting your speaker
Living la Vida
Like Daniel, I be smarter than teacher
Even if I fall when I ran kilometre
Daddy steady picking me up

Even when I fall your hand
You still dey hold my hand
Lover of my soul, You nor dey break my heart
I'll sing about your mercy
I'll sing about your grace
Na u dey burst my brain
Every night and day
Daddy wey dey pamper
Daddy wey Dey bless
Forever you're my father
Na u dey give me rest
When I look around
I see your faithfulness
I'll bow down on my knees
Cos na u wey be the best

Me I know say u no dey sleep
You no dey slumber
And you just dey follow the boy bumper to bumper
When a bad man wan try to double cross - me
You tell me say make I dey my dey
Nothing dey kpai

So perm one side like jerry curl
Dem no go fit to use me dey toy
Dem go hear the foot steps koi! Koi! Koi!!
Oluwa dey for the boy boy

Say me I like the way you pamper me like a Tata
When the enemy knack shot Ratatata
Everything e just dey bounce
You dey counter
Say your name e no be child's (play)
So me I no go Jas down

I remember one day for mother cast
Many bad men dem Conner side me o
And you prepare my table before them say make I chop à la carte

Even when I fall your hand
You still dey hold my hand
Lover of my soul, You nor dey break my heart
I'll sing about your mercy
I'll sing about your grace
Na u dey burst my brain
Every night and day
Daddy wey dey pamper
Daddy wey Dey bless
Forever you're my father
Na u dey give me rest
When I look around
I see your faithfulness
I'll bow down on my knees
Cos na u wey be the best

Daddy oh Daddy
This your love dey sweet my belle
Oh Daddy oh Daddy
This your grace e dey show for body

Instruments



Credits
Writer(s): Godwin Udofia
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link