My Car

Tetui where you dey go wetin you dey find
Why you dey ask me that kind question
Say where I dey go
Where I dey go I dey come l dey come
You don hit my car (Oyinbo repete)
I say you don bash my car (Gbese repete)
Tell me you don hit my car (Oyinbo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Wetin you dey find
Where you dey go
As I dey waka dey go like so
Me I am looking for this paddy
This paddy owe me plenty money
They tell me say him they dey Ikoyi
Me I get Didis for one party
Seri paddy yen ofe kpa mi
Today na today no time for story
Tin ba dele re ti n gba mu
He must to pay me all the money
I come reach him say I come see say
People gather dey just dey cry
I try to know wetin cause the cry
Dem tell me say my paddy don kpai
As I con dey go back to my house
I come meet small hold up for road
The next thing wey I hear for my back
Na one scratch from another car
Ehn ehn you don hit my car (Oyinbo repete)
I say you don bash my car (Gbese repete)
Eh tell me you don hit my car o (Oyinbo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
See me see trouble ooh another gbese
Dead body no dey pay person money
Another paddy don dey bash my car
Today na today no time for story
Ah Eedris na you see wahala
Hey whatsup Tony whatsup man
Ebe long time wey no see whatsup man
Ol boy stop that yarn o wetin be whatsup
You bash my car you dey tell me say whatsup
Shey na whatsup I go use spray my car
I beg pay me my money
Police con come dey measure the line
Dem say make I no worry everything go be fine
Dem bring the paper say I make sign
I sign my own Eedris sign him own
I con dey wander who get the fault
Dem say na my paddy get the fault o
I pack my car see trouble
Yanga dey sleep trouble come wake am
He he
You don hit my car (Oyinbo repete)
I say you don bash my car (Gbese repete)
Eh tell me you don hit my car (Oyinbo repete)
As you don bash my car (Gbese repete)
Huh somebody o somebody wey (My car ar car a a a)
You don kissin ni bobon kolo (My car ar car a a a)
Shey na girigiri you dey take drive car (My car ar car a a a)
Shey is good (My car ar car a a a)
Somebody wey were bobon kolo fit kolo (Car ar ar)
Begin dey drive car ka kai kai (Car a a)
Don kolo girigiri (Car a a a)
Palaver hard to carry for head
Money no dey pocket for man to spend
One of my paddy wey dey owe me money
I reach im house they say he don kpai
Another don dey bash my car
Wetin I go do e no get money
I con think say this stress no worth am
Today be na own tomorrow fit be my own
I come tell my paddy make he come dey go
Den I to push my car from road
As I push am small wetin I see
Na government car come bash my car
Again
You don hit my car (Oyinbo repete)
I say you don bash my car (Gbese repete)
Tinubu you don hit my car (Oyinbo repete)
My own don better o (Owo repete)
You don hit my car (Oyinbo repete)
My own don better o (Owo repete)
Tinubu you don hit my car (Oyinbo repete)
My own don better o (Owo repete)
Tinubu you don hit my car (Oyinbo repete)
My own don better o (Owo repete)
Tinubu you don hit my car (Oyinbo repete)



Credits
Writer(s): Brian Ward, Michael Hartnett, Richard Stephens, Rasheed Hightower, Jason Pittman, Demetrius Hardin
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link