O.D.O.O. - Edit

Ah! I beg let us get down
Into another underground spiritual game
I beg, after my "pass o, pass o"
You go dey help me end am with "wen"
Because them go hear wen, yeah!
Pass o, pass o, pass o, pass o

Wen
When they want to call, eh
When they want to call, eh
When they want to call Nigerian government
Them give am name, "Federal Military Government"
(Federal Military Government)
For Libya dem give am name, "Liberation Council"
(Liberation Council)
For Liberia dem give am name, "Redemption Council"
(Redemption Council)
For Zaire dem give am name, "Revolutionary Council"
(Revolutionary Council)
Them get different different names
For different different governments
But the correct name for them
Na, "Soldier go, soldier come"

Soldier go, soldier come
Soldier go, soldier come
Soldier go, soldier come
Federal Military Government
Libya Liberation Council
Liberia Redemption Council
Zaire Revolutionary Council
Soldier go, soldier come
Soldier go, soldier come
When Obasanjo and Yar'Adua
Chop belly full and go
Them put civilian friends for there
Them shout, "Second republic"
People wey no know dey happy
People wey know them dey look
Them baptize the civilian government
Them name am federal government
Me I know by their name
Me I call them, "Soldier put, soldier go"

Soldier go, soldier come
Soldier come, soldier go
Na so our lives for Africa dey roll
Since them say we get independence
The civilian government wey them dey
Na soldier dey protect them
When our lives roll small
He go go knock head for wall
When our lives roll small
He go go knock head for tree
When our lives roll small
He go go knock head for stone
When I see say our lives dey roll
Like one yeye ball
Wey one yeye wind
Dey blow from one yeye corner
I put my mouth for song
"Kalakuta Show"

Yeye rolling
Gaga gugu, gaga gugu
Yeye rolling
Look the man he dey waka
Hungry dey run for him face
I put my mouth for song:
"Mr. Follow Follow"

Yeye rolling
Mr. Follow Follow
Mr. Follow Follow, make you open eye
Mr. Follow Follow, make you open sense
I put my mouth for song:
"Zombie o, Zombie"

Yeye rolling
Zombie o, zombie
Zombie no go go unless you tell am to go and stop
Attention, quick march, left turn
Right turn, about turn, quick march
Quick march, left turn, right turn
About turn, quick march, left turn
I put my mouth for song
"Shuffering and Shmiling"

Yeye rolling
Suffering and smiling
Every day my people dey inside bus
Forty-nine sitting, ninety-nine standing
Them dey faint, them dey wake like cock
Every day na the same thing
I put my mouth for song
"Unknown Soldier"

Yeye rolling
Unknown soldier
That my mama wey you kill
She is the only mother of Nigeria
Which kind injustice be this?
Wetin concern government inside?
If na unknown soldier
Them turn blue into red
Them turn pink into green



Credits
Writer(s): Fela Anikulapo Kuti
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link